fbpx
April 19, 2024

Akwa Ibom decides: 15 parties don sign peace accord

15-parties-don-sign-peace-accord

Ahead of March 18 governorship and State House of Assembly elections, di Nigeria Police, Akwa Ibom State command don organize peace accord for di candidates.

Di governorship candidates of all di major political parties dey present for di event.

As di event dey go on, di parties wey dey present na: PDP, APC, YPP, LP, NNPP, ACCORD, ZLP, PRP, APM, AA, ADP, AAC, APGA, SDP and BP.

For di command headquarters, Ikot Akpanabia, di Commissioner of Police, CP Olatoye Durosinmi advise di candidates ay make dem warn dia supporters against any kind of violence or to dey hire thugs. Hin yarn say di police no go hesitate to fight anybody wey engage in such act.

Durosinmi mention say di peace accord or Akwa Ibom na to promote peace for every aspects and to make candidates avoid inflammatory comments wey fit caue violence before, during or after di polls.

FOR MORE NEWS: Delta: PDP guber candidate escape gunmen attack

 

While hin promise to ensure security during di March 18 elections, di CP encourage members of di public say make dem come out en-masse to vote candidates of dia choice without fear of molestation.

Inside hin remarks, di State Resident Electoral Commissioner (REC) of INEC, Dr Cyril Omorogbe, wey dey represented by di Administrative Secretary, Mr Emmanuel Ogbodu, promise a level playing ground for all di candidates, even as hin maintain say INEC still be “unbiased umpire for di elections.”

Also, hin reassure pipo say di materials go reach di at polling units on time.

Di gubernatorial candidates for dia separate remarks advise INEC make dem remain unbiased umpire and deliver free, fair and credible elections unlike wetin dem do during di February 25 presidential election.

You fit go read di full tori…READ MORE