fbpx
April 19, 2024

2023 general elections: Una for no waste N300bn – Simi slam INEC

2023-elections-simi-slam-inec

Popular Nigerian singer and songwriter Simisola Bolatito Kosoko, wey dey known by her stage name Simi, don slam di Independent National Electoral Commission, INEC, over di conduct of di 2023 general election.

Di singer feel say di electoral process dey disappointing and e no level up to di N300 billion wey dem use conduct di elections.

Also, as Simi slam INEC, she slam Nigerian youths, especially di ones wey make themselves tools for di hands of desperate politicians, and she remind dem say politicians only care about themselves.

FOR MORE NEWS: Announce rightful winners for Abia, Enugu or expect ENDSARS-like protests – Coalition

Di singer dey react to di violence and irregularities wey spoil di February 25 and March 18, 2023, elections.

“And all these for politicians that don’t give af about you or your family. ‘Them just dey use you’. When this election has passed, it’ll be you, the poverty you’re dying to maintain and your newfound lack of shame. They still won’t care about YOU. Tribalism is disgraceful,” Na wetin she tweet be dat.

In addition, she yarn say di 300 billion naira budget for di joke of an election. Also, she mention @inecnigeria say dem suppose give dem back di money to fix some hospitals and schools and just use finger point di pipo wey dem plan to select.

You fit go read di tori…READ MORE