fbpx
September 29, 2024

BREAKING: Buhari Don Meet With Tinubu For Villa, Fresh Details Emerge

buhari-meet-with-tinubu-for-villa

President Muhammadu Buhari meet with di presidential candidate of di All Progressives Congress (APC), Bola Tinubu, for hin official residence wey dey di State House, on Friday, February 10th.

Tinubu bin don abandon di ‘Meet the mentor’ dinner wey dem hold in honor of di APC Progressives Sisters Network for di International Conference Centre for Abuja. And hin apologise to di organisers say hin bin need to attend another important meeting with di president at 9.45p.m.

Although di agenda of why Buhari meet Tinubu still dey unknown. Also, dem neva revael anything to di public. However, some close pipo reveal say e fit dey unconnected with last-minute strategies and logistics wey dey connected with di presidential election. Also di election dey planned to hold in two week- time.

FOR MORE NEWS: 2023: ‘PDP don bring us shame, make dem no retain power’ – Na Ayu tok this one for Kano campaign

Meanwhile, di Buhari/Tinubu meeting for di State House end for midnight. And den neve issue any statement on the meeting.

Meanwhile, di Council of State express support for di Naira redesign policy of di Central Bank of Nigeria (CBN). Council members voice out about dia their position during  meeting wey dem hold for di Presidential Villa on Friday, February 10.

Also, na President Muhammadu Buhari head di meeting. And di pipo wey dey in attendance include Vice President Yemi Osinbajo, Former Head of State Gen. Abdulsalam Abubakar, Former President Goodluck Jonathan, and Former Head of State Gen. Yakubu Gowon.

You fit go read di full tori…READ MORE