fbpx
September 29, 2024

“Only death fit remove us” – Ekiti National Assembly candidates dey vex as PDP expel them

pdp-expel-assembly-candidates

Five members of di Peoples Democratic Party, PDP, for Ekiti State don kink againt dia reoval from di party. Dem bin dey run for di Senate and House of Representatives for di forthcoming elections. According to report, di National Working Committee, NWC, of di main opposition party PDP bin expel five National Assembly candidates for di State. This matter happen on Friday.

Also, di reason why dem suspend di candidates from di party na because of alleged anti-party activities.

Some of di candidates react to di development. Also, dem yarn say na only death fit stop them from running and winning di February poll.

Inside statement wey dem issue on Friday, di candidates describe di removal as something wey no dey important. As PDP expel di five National Assembly candidates, di candidates yarn say  na clear disrespect for di laws of di party and that of di country.

According to them, di “lawlessness of di party’s National Chairman, Senator Iyorchia Ayu and di National Working Committee, NWC, go fail.

Also hin mention di “Section 33 of di Electoral Act, 202. E state say ‘a political party no fit dey allowed to change or substitute di candidates wey don submit name under Section 29 of this Act. However, di exception na for di case of death or withdrawal of a candidate.

You fit go read di full tori…READ MORE