fbpx
March 28, 2024

Atiku UK trip: Abi hin dey suffer ill health

Atiku-Ill-Health-and-trip

Some tori bin dey everywhere on Sunday say dem fly presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar comot for country. Thi trip na for urgent medical attention. Abi hin dey suffer ill health?

Di spokesperson for di PDP campaign council don put mouth for di matter. Hin yarn say no be true say di rumor na  joke of the year.

On top di Atiku ill health matter, newspaper report say dem fly di former Vice President on Sunday from Dubai. From United Arab Emirates to London, United Kingdom, na treatment hin go for.

“Atiku no well, hin dey hospital dey receive treatment, this na di reason why hin neva come back Nigeria for di presidential campaign. 

FOR MORE NEWS: Go get your PVC, vote for God’s ordained – Pastor Adeboye

“Na Dubai hin bin dey but hin don comot go London for treatment, Dem fly am go UK for treatment, na wetin make am still dey abroad,” Na di small newspaper quote di unnamed PDP source

Di media adviser to Atiku, Mr Paul Ibe, say PDP candidate go enter London on Monday.  This one na after hin don say make pipo no mind di rumor of Atiku ill health.

 “For the avoidance of doubt, presidential candidate of the PDP and former Vice President of Nigeria (1999-2007) will be arriving in London on Monday, January 9 for meetings on Tuesday and Wednesday on the invitation of the British government.” Na wetin Ibe tok for hin verified twitter handle  be that.

You go like go read more of this tori…READ MORE