fbpx
March 29, 2024

Disappointed – Ronaldo react as Al-Nassr lose to Al Ittihad

-ronaldo-react-as-Al-Nassr-lose-to-Al Ittihad

Al-Nassr captain, Cristiano Ronaldo, don react to hin side Saudi Pro League 1-0 defeat as dem lose to Al Ittihad on Thursday.

Ronaldo bin no fit help Al-Nassr as dem lose to Al Ittihad for di King Abdullah Sports City.

Romarinho score di only goal of di game for di 80th minute, rounding off counter-attack.

Di result means say Al-Nassr dey one point behind league leaders Ittihad for di Saudi Pro League table.

FOR MORE NEWS: Governorship election: YPP collapse dia structure to PDP for Benue

Reacting, Ronaldo yarn say hin dey disappointed with di outcome of di match.

Also, di former Manchester United forward encourage Al-Nassr make dem stay focused ahead of dia upcoming games.

Ronaldo write on top Instagram: “Disappointed with the result, but we stay focused on our season and the games ahead.

“Thank you Al Nassr fans for your support, we know we can count on you!” Na wetin hin tok be dat.

You fit like go read di full tori…READ MORE