fbpx
April 25, 2024

El Clasico: We’re hurting – Ancelotti don give reason why Real Madrid fall 12 points behind Barca

ancelotti-tok-why-real-madrid-fall-12-points-to-defeat-behind-Barcelona

Real Madrid boss Carlo Ancelotti don admit say hin players dey sad and e dey pain dem after a damaging El Clasico defeat to Barcelona

Di Real Madrid defeat put Los Blancos 12 points behind Barcelona for di race for di title dis season despite di champions impressive display for di night.

Also, di Italian tok say Barcelona dey more consistent in winning matches dis season while hin explain why Real Madrid find themselves so far behind in di title race,

“It’s simple, they’ve been more consistent than us this season. “We’re sad and hurting, but we’re proud of the performance,” Ancelotti tell reporters after di game.

FOR MORE NEWS: Lagos governorship election: Sanwo-Olu don tok after victory

He yarn say Los Blancos, wey get dia second goal of di night don come back to dia normal way of playing football. Also, hin insist say e no  think say dem deserve to lose today.

“Our January let us down a lot, just after the World Cup. Now, we’re doing well and I think we’ll finish the season well.”

Ancelotti hope of ending di season well fit be for di Champions League, where dem don make am to di quarter-finals.

For di draws wey dem conducted on Friday, Real Madrid go face Chelsea for di quarter-finals of Europe’s elite competition.

You fit go read di full tori…READ MORE