fbpx
March 29, 2024

Lagos: Stop anti-Igbo violence, na genocide – Nnamdi Kanu lawyer, Ejimakor to Yoruba leaders

anti-igbo-violence-na-genocide-Aloy-Ejimakor-tell-Yoruba-leaders-

Aloy Ejimakor, di Special Counsel to Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra, IPOB, don advise Yoruba leaders make dem stop di anti-Igbo violence for Lagos State.

Ejimakor describe di anti-Igbo violence for Lagos State as a mini-genocide.

Inside tweet, Aloy Ejimakor lament about di silence of Yoruba leaders, and he stress say dia actions dey questionable.

He write: “Dear Yoruba leaders: I demand that you immediately halt the anti-Igbo violence raging in LAGOS. It’s a mini-GENOCIDE & your silence makes you complicit when time for reckoning comes.

FOR MORE NEWS: BREAKING: INEC declare APC Abdullahi Sule winner of Nasarawa governorship election

Also, hin tok say hin no be Igbo leader, but he dey sure say 70 million Igbos worldwide dey with am on di matter. Oh, #MNK.”

Following di outcome of di presidential election for Lagos State, Yorubas and Igbos no agree with dia selves again.

In an attempt to ensure say All Progressives Congress, APC, no lose for Lagos State during di governorship election, one video of di State Parks Management Committee Chairman, Musiliu Akinsanya, popularly known as MC Oluomo appear online. Hin bin dey threaten Igbos.

MC Oluomo warn Igbos wey no go vote for APC say make dem stay inside dia house.

Ahead of the governorship election, some markets wey Igbos plenty dey burnt down for Lagos State.

You fit go read di tori…READ MORE