fbpx
March 28, 2024

Lagos dey proud of Sanwo-Olu achievements – APC knock PDP

apc-deny-pdp-claims

Di Lagos chapter of di All Progressives Congress, APC, don deny claims by di Peoples Democratic Party, PDP, say Gov. Babajide Sanwo-Olu achievements for hin first term in office dey characterised by an increase in poverty and unemployment.

Also, News Agency of Nigeria (NAN) reports say PDP Publicity Secretary, Alhaji Hakeem Amode, inside statement on Tuesday, yarn say di party dey surprised by Sanwo-Olu claim during hin second term swearing-in ceremony wey hin meet resident expectations.

 

FOR MORE NEWS: Kogi Guber polls: Two PDP Assembly candidates don join APC

 

Di party, describe Sanwo-Olu T.H.E.M.E.S. agenda as total failure, he yarn say di Governor no fit justify di huge amount of money wey hin spend on budgetary allocations for di last four years compared to hin predecessors.

According to PDP, Sanwo-Olu’ proposed T.H.E.M.E.S Plus agenda for hin second term show say hin get nothing to offer di pipo

But inside quick reply, di APC Publicity Secretary, Mr Seye Oladejo, inside statement on Wednesday yarn say residents of di state still dey proud of di party achievements in public transportation, healthcare, education, di environment, job creation, tourism, security and safety, sports, youth and women development, among others.

You fit go read di tori as APC deny PDP claims…READ MORE