fbpx
April 18, 2024

APGA don elect new national chairman, reconstitute board of trustees

apga-elect-national-chairman

Members of di All Progressives Grand Alliance, APGA, don elect Barr Sly Ezeokenwa as di national chairman of di party.

Also, dem elect other members of di National Working Committee, NWC.

Di party hold di national convention for Awka, Anambra State capital, where dem elect di 31 officers through voice vote.

Also, di out-gone national chairman, Victor Oye as hin dey hand over, yarn say hin leadership don give di party a national secretariat for Abuja and five-storey edifice as di South east regional secretariat of di party.

He reveal say with dat achievement, APGA fit rank as di only political party with permanent secretariat for Abuja.

 

FOR MORE NEWS: Lagos dey proud of Sanwo-Olu achievements – APC knock PDP

 

Also, di new national chairman, Ezeokenwa for hin acceptance speech appreciate di Governor, Prof Chukwuma Soludo and hin faith in change wey don produce am as di youngest national chairman of a major political party for Nigeria.

Members of di board include di out-gone national chairman, Oye; governorship candidate of the party in Enugu, Frank Nweke Jnr; Senator representing Abia South, Senator Enyinaya Abaribe; former member representing Orumba North and South for House of Representatives, Hon Ben Nwankwo and di speaker of Anambra State House of Assembly, Rt Hon Uchenna Okafor, among others.