fbpx
March 28, 2024

Police don declare Ebonyi APGA governorship candidate wanted

apga-governorship-candidate-wanted

Di governorship candidate of di All Progressive Grand Alliance APGA for Ebonyi state, Ifeanyi Odoh, dey declared wanted by di police.

 

Ifeanyi Odoh

 

APGA governorship candidate, Ifeanyi and nine others dey declared wanted on Monday, March 6, over di murder of a monarch, Igbokwe Ewa. Di traditional ruler of di Umu-Ezekoha community for Ezza North local government area kpai for hin hometown last Monday, for di hands of unknown gunmen.

FOR MORE NEWS: Shehu Sani don caution pipo wey dey refer to di President-elect, Bola Tinubu as drug baron

 

Ebonyi police spokesperson, Onome Onovwakpoyeya inside statement tok say;

“Di Ebonyi State Police Command don declare di under-listed persons wanted in connection with di murder of his Royal Highness Eze Christopher Igboke Ewa of Umu-Ezekoha Community for Ezza North.”

Others pipo wey di police declare wanted na Samuel Onyekachi Aligwe, Peter Orogwu (aka one boy),Chukwudi Aliewa (aka Ezza), Chika Ezealigbo, Nnaemeka Egede (aka Champaign), Nnabuike Okohu, Ogobuchi Agbom (aka Okiri), Nonso Obasi, Ikechukwu Nwoba (aka Solid).

Youfit go read di full tori…READ MORE