fbpx
March 29, 2024

Presidential polls: Atiku, Obi move to replicate Kenya, Malawian rare judgements

atiku-obi-move-to-replicate-kenya

Weeks after di presidential election, plenty Nigerians don keep hope alive as dem believe say dia preferred candidate fit dey declared winner, dis time, no be by di Independent National Electoral Commission, INEC, but by di court di last hope of the common man. Atiku and Obi don make move to replicate Kenya, Malawian rare judgements.

According to di laws of di land, INEC don do dia job as dem conduct, conclude and declare di winner of di presidential election. Di electoral umpire also dey bound by law to review some of dia decisions as demanded by some political parties during di collation of results.

Also, dem tok say di election witnessed cases of irregularities, votes suppression, massive rigging, manipulations (in the form of rewriting of results and destruction of ballot boxes).

During di collation of results for di national collation centre of di INEC, Abuja, some political parties stage walkout as di Commission no gree stop di collation of results and to review di process.

FOR MORE NEWS: Rivers Guber: Wike na drunk, hin dey spend N50m every week on alcohol – Amaechi

Di Commission continue with di process and dem announce di candidate of di All Progressives Congress, APC, Bola Ahmed Tinubu as di winner of di election,

However, di presidential candidates of di Labour Party, LP, Peter Obi and di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar, don tok dia mind say dem dey go court.

Peter Obi sef tok say na hin win di election and hin express hope say hin go reclain di mandate wey hin say dem steal from am for di apex court, also hin vowing to do anything necessary within di law.

E show say plenty Nigerians no like di outcome of di result.

And as Nigerians on both sides of the coin dey wait patiently for di final verdict of di Supreme Court, supporters of di opposing political parties and candidates Atiku and Obi dey hope say di Kenya and Malawi judgements go be di same for Nigeria, while di once wey dey di other side of victory no go fancy am as historic ruling.

You fit go read di full tori…READ MORE