fbpx
March 19, 2024

Arrest MC Oluomo before you call for reconciliation – Atiku tackle Tinubu

atiku-tackle-tinubu-as-he-rubbish-hin-call-for-reconcilation

Di 2023 Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar don rubbish di reconciliation call by di President-Elect, Bola Tinubu.

Atiku say make Tinubu arrest and prosecute di former Lagos State National Union of Road Transport Workers, NURTW, chairman Musiliu Akinsanya, also known as MC Oluomo, for threatening Igbos during di governorship election.

As Atiku rubbish Tinubu reconciliation, hin yarn say Tinubu call for reconciliation na package of lies and hypocrisy.

FOR MORE NEWS: Judgment Day: Tension for Osun as Adeleke, Oyetola know fate

Following di conduct of di 2023 general elections, Tinubu don advise hin opposition say make dem give room for healing.

Tinubu yarn say pipo wey dey affected by di violence need to put dia differences for one side for di sake of national interest and unity.

Hin tok dis one through hin Media Aide, Phrank Shaibu.

Atiku don tok say reconciliation no go happen until MC Oluomo and all hin minions wey follow threaten and brutalize pipo dey prosecuted.

You fit go read di tori…READ MORE