fbpx
April 19, 2024

Australia don ban TikTok on government devices

australia-don-ban-tiktok

Australia don announce say dem go ban di popular social media app TikTok on government devices due to concerns over national security.

Attorney-General Mark Dreyfus yarn say di decision dey based on advice from intelligence agencies and e go take  effect “as soon as practicable”.

As Australia ban tiktok, di move dey in line with dia Five Eyes security alliance partners, di United States, Britain, Canada, and New Zealand, wey don already ban di app.

France, di Netherlands, and di European Commission don take di same measures. Di ban dey come amid concerns say di Chinese-owned app fit dey used to collect data, share with di Chinese government.

Cybersecurity experts don warn say di app extensive data collection fit pose significant privacy and security risks.

While the ban dey limited to government devices, it is estimated say around seven million Australians, or one-quarter of di population, dey use di app.

You fit go read di tori…READ MORE