fbpx
April 24, 2024

Wetin make we Yoruba boys do with our Igbo wives and children? – Comedian AY Makun query as he react to Lagos election

ay-react-to-lagos-election

Nigerian comedian and actor, AY Makun, don react to di events wey happen for Lagos during di recently-concluded Presidential and Governorship elections.

You go remember say di electoral process for Lagos bin witness tribal discrimination and bigotry.

Many Igbos and those were no plan to vote for di All Progressives Congress (APC) no see chance vote for some polling units for di state.

Also, serious tribal war bin dey between some Yoruba and Igbo folks on top social media following di gubernatorial election last Saturday, March 18.

FOR MORE NEWS: I don finish my earthly ministry, and I go soon d!e — Prophet Odumeje announce

In response to di tribal battle, AY Comedian react to Lagos elections and he ask for Twitter say wetin pipo for inter-tribal marriages go do. He specifically ask say wetin Yoruba men wey marry Igbo women go do about dia partners and children.

AY, wey marry Delta-born woman Mabel, follow throw a small jab at Nigerian politician, Femi Fani-Kayode, wey dey supporter tribal war.

For inside hin tweet, hin write,

“Now that d elections are officially ‘over’ in Lagos State, I am sure all these talks about BIGOTS & MAGGOTS will end on d lips of some COCONUT heads like d FOOLISH FEDERAL KOLA-NUT (FFK) seekers, Una for tell us wetin una want we Yoruba boys to do with our Igbo wives & children.

I just weak …..I don’t feel like a Nigerian no more …

D national anthem so heavy for my mouth now”

You fit go read di tori...READ MORE