fbpx
April 20, 2024

Bobrisky drop N20 million to feed Christians, Muslims wey dey fasting

bobrisky-reveal-n20-million-budget

Crossdresser, Idris Okuneye aka Bobrisky don reveal say he budget N20 million to cook for Christians and Muslim faithfuls’ wey dey observe fast.

Christians start dia lent (fasting) for February and dem go conclude am for April after 40 days to mark Easter. Muslims start dia Ramadan (fasting) for March and e dey  scheduled to end later in April 2023.

Bobrisky take to hin social media page to announce say hin go use di money feed pipo wey dey fasting for days.

As Bobrisky reveal N20 million budget, he yarn say hin no go stop to show kindness or change hin humanitarian nature towards pipo even though dem no appreciate hin efforts and gestures.

HE WRITE; “I BUDGET (20MILLION) FOR COOKING FOR PEOPLE FASTING DAILY. I WILL NEVER CHANGE MY KINDNESS TO PEOPLE EVEN DESPITE MANY OF THEM ARE INGRATE.”

FOR MORE NEWS: PDP don deny say dem suspend Iyorchia Ayu

Social media users no believe say Bobrisky get dat amount of money to give out even for reasonable cause.

abisoyeayotunde1; Pele ooo federal government

sdq_official; Omo if this guy join politics. Lai Muhammad go learn from am

crazilyimatured; Just do your thing and let God reward you the post took all the credit so if you do it you have no reward from God

You fit go read di tori…READ MORE