fbpx
April 23, 2024

Singer Burna Boy cause stir as hin expose hin sister real age for her birthday party

burna-boy-expose-hin-sister-age

Popular singer,Damini Ogulu, better known as Burna Boy don cause buzz online. Dis na after Burna boy expose hin younger sister Nissi Ogulu real age for her birthday party.

Nissi clock new age on Tuesday, March 14, and she throw party with few friends and family in attendance to mark di special day.

Burna Boy, wey also attend di party, give speech to celebrate hin sister and hin decide to question hin sister for hiding her real age after hin see di inscription on top her birthday cake.

E dey clear say hin sister tell di baker make she write “29 + 1” on top di cake just to play down her real age.

FOR MORE NEWS: ‘Is it because I didn’t come online to beg for money?- Ronke Oshodi Oke don reveal why she lose weight

Also, reacting to her coy move, Burna Boy ask her why she dey lie about her age. Before person know wetin dey happen,  Burna boy don open mouth expose Nissi age to guests say she dey turn 30.

Video of di moment wey hin expose her age dey trend online. As di matter be so, e don spark reactions from netizens.

@sharonofficial126 write, “All these elder siblings too Dey do over sabi  must una disgrace us for public? Who ask you? I use this as a point of contact to my elder brother  try rest bros you too do”

@niesia write, “Hiding your age is the most unnecessary thing girls do in nigeria very unnecessary”

@wf_annabelle write, “Wahala for who go tell Burna and Portable hin secret”

@dbmdaisy write, “I don’t know why 30 Dey fear us especially if you aren’t married ”

You fit go read di full tori…READ MORE