fbpx
March 29, 2024

Burna Boy don ready to perform for 2023 UEFA Champions League final

burna-boy-ready-for-2023-uefa-ready-for-2023-uefa

UEFA reveal say Burna Boy na one of di performers for di 2023 Champions League Final. Di announcement come out via di Champions League official Twitter handle on Thursday, 16th March 2023.

Also, inside di video wey dem post for Twitter,  Burna Boy wey dey happy reveal say hin go perform for di Champions League final. Di event go hold for Istanbul Turkey.

In addition, Burna Boy go become di first Nigerian artist to perform for di biggest stage of European Club football.

 

FOR MORE NEWS: Naira Marley dey stand with Sanwo-Olu for second term

 

Since hin gain international success in 2018 through hin hit single ‘YE,’ Burna Boy don become one of di biggest artists for di world. In addition, hin don earn Grammy award for hin album ‘Twice As Tall’. Dis na even as hin become one of di most award artists for continent.

Burna Boy don sell out choice arenas around di world as hin music continues to attract international listeners.

Di UEFA 2023 Champions League Final go take place on 10th June 2023 for Istanbul Turkey and Afrobeats go share di stage as two of di finest clubs for Europe compete for di biggest price.

You fit go read di tori…READ MORE