fbpx
April 19, 2024

CBN ends cash swap programme in rural areas

cbn-don-end-cash-swap-programme

Di Central Bank of Nigeria CBN yarn say residents of rural and unbanked areas no go fit swap old notes for new ones through dia cash swap programme because dem wan end am.

CBN Acting Spokesperson, Isa Abdulmumin, drop dis update for inside telephone chat with. Also, hin yarn say di programme don fulfill hin mandate.

However, di Association of Mobile Money and Bank Agents for Nigeria don describe di programme as ineffective. Hin insist say di participation by stakeholders dey minimal.

As di cash swap programme wan end, di CBN bin tok say di cash swap programme suppose help citizens for rural areas or di ones wey no get access to formal financial services to exchange old naira notes for di redesigned notes.

FOR MORE NEWS: Naira redesign: Kaduna churches don lose millions as tithes, offerings reduce

To promote financial inclusion, di CBN no join mobile money/Point of Sales agents for Abuja and Lagos. Dem maintain dia ground say di service dey available for anybody wey no get bank account.

Also, dem mention say na only N10,000 dem go fit eleaseper customer under di cash swap programme.

But inside assessment, AMMBAN National Publicity Officer, Oluwasegun Elegbade, yarn say di recent mob attacks on banks for no happen if di programme fulfill hin purpose.

You fit go read di full tori…READ MORE