fbpx
March 19, 2024

Naira crisis: CBN don release old notes to commercial banks

cbn-release-old-notes-to-banks

Di Central Bank of Nigeria, CBN, don set to release all N1,000, N500 and N200 old notes wey dey dia custody to Deposit Money Banks.

One source for di CBN na hin give dis update on Wednesday.

According to am, di apex bank don conclude plans to disburse old notes to Deposit Money Banks across di country starting from Thursday (today).

He add say di development go end di two-month-long Naira scarcity for Nigeria.

Dis update dey comes on di heels of di Nigeria Labour Congress, NLC, wey plan nationwide strike and protests for CBN offices following di hardship wey di bank naira redesign policy bring.

FOR MORE NEWS: Odumeje declare Nigerian leaders failure, condemn attack on Igbos for Lagos

Di CBN latest decision to release old notes come several weeks after di Supreme Court give order say make old N1,000, N500 and N200 notes remain legal tender until December 31, 2023.

Economic expert, lecturer for Lead City University, Ibadan, Prof Godwin Oyedokun, don tok say di CBN dey willing to release cash to commercial banks after di general elections.

He explain say since di polls dey over, di CBN go begin di disbursement of di new and old notes.

According to report, CBN bin mop up N2.3 trillion at the end of February from N3.9 trillion currency wey dey in circulation in October last year.

You fit go read di tori…READ MORE