fbpx
March 29, 2024

China population don reduce for di first time in 60 years

china-population-don-reduce-for-di-first-time-in-60-years

China population don reduce for di first time in 60 years. Na di official data show this update on Tuesday as di world most populous country dey face coming demographic crisis.

Di birth rate of di nation don drop. With di way wey e take drop, analysts warn say e fit slow economic growth.

Chinese mainland population bin dey around 1,411,750,000 at di end of 2022, e show decrease of 850,000 from di end of di previous year. Na Beijing National Bureau of Statistics give this report.

NBS yarn say di number of births na 9.56 million before, while di number of deaths bin stand for10.41 million.

FOR  MORE NEWS: Na hin papa carbon copy – Netizen Reactions to Regina Daniels second son

Di last time wey China population drop na early 1960s, as di country bin dey battle di worst famine.

China bin end dia strict one-child policy wey dem bin impose for year 1980s because of fears of overpopulation – But dem later start to allow couples get three children in 2021.

As di matter be so, that one still fail to reverse di demographic decline for country wey don dey rely on dia workforce as a driver of economic growth.

Zhiwei Zhang of Pinpoint Asset Management yarn say di population still fit dey go down for di coming years.

“China no fit rely on di demographic dividend as structural driver for economic growth.”

“Economic growth go need to depend more on productivity growth, wey dey driven by government policies,” Na wetin di man till add be that.

China population don reduce for di first time in 60 years, go read di full tori …READ MORE