fbpx
April 25, 2024

Plenty pipo fit don kpai as Shi’ite members clash with El-Rufai convoy for Kaduna

clash-with-el-rufai-convoy-for-kaduna

Security operatives wey dey attached to di convoy of di Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai on Thursday evening, clash with Shi’ite members for Bakin Ruwa Area of Igabi Local Government Area of Kaduna State.

Di development, according to reports, lead to di death of at least four persons, while plenty other pipo get serious injury.

E dey gathered say di governor convoy came in contact with di Shi’ite members when dem dey perform dia weekly procession for Bakin Ruwa along Nnamdi Azikiwe Expressway.

FOR MORE NEWS: Lagos elections result transmission: APC, SDP dey find leave to appeal court judgment

According to report, one Shi’ite representative for Kaduna state, Abdullahi Usman, wey confirm di incident, yarn say none of di pipo wey kpai na dia member.

Also, di spokesperson of di Kaduna State Police Command, DSP Mohammed Jalige, follow confirm di incident. Hin yarn say dem dey do investigation and, dem go issue statement later.

You fit go read di full tori about di clash with El-Rufai convoy for Kaduna…READ MORE