fbpx
April 25, 2024

Couple discover say dem be cousins after 17 years and three kids together

couple-discover-say-dem-be-cousins

A happily married couple, Celina and Joseph Quinones, just discover say dem be cousins after dem take family tree DNA test.

Di pair, from Colorado don dey together for 17 years and dem get three beautiful children together. Dis na when di wife, Celina, decide to dig into her family tree.

Also, di mother-of-three neva even go deep into her lineage when she discover say her husband, Joseph, na her cousin.

As she share her story via her TikTok handle, @realestatemommas, she describe di moment when she first discover say her husband na her cousin.

FOR MORE NEWS: Viral video: Portable get 75-hour to report self to police

According to her, she and her husband marry in 2006 and dem get three kids, only to find out years later say she and her husband dey related.

“Married my husband in 2006. Not thinking anything of it we had three kids. Come to find out we were related and cousins.”  Na wetin she write be dat.

Celina advise other couples make dem check dia heritage as dem wey be couple discover say dem be cousins.

Inside video wey she later share, she reveal say her family don move past di discovery since her children no dey affected by any genetic disorders or abnormalities.

You fit go read di tori…READ MORE