fbpx
April 24, 2024

Guber Election: Delta workers close office early for Omo Agege

delta-workers-show-for-omo-agege

Civil Workers for Delta State don receive assurance of better deals if dem vote for di gubernatorial candidate of All Progressives Congress and deputy Senate president, Ovie Omo Agege come Saturday election.

Di Delta workers wey pack dia sef come out in large numbers to di Grand Hotel for Asaba on Monday to hear di final word from di candidate Omo Agege before di election bin don rush close early for di day. Dis na so dat all of dem go fit go di venue.

According to reports, some workers reach di venue before 3 pm and dem form long queues to register in groups. Dis na before di candidate address dem around 5.30 pm.

Also, di majority of dem stand for outside for hours as dem no fit enter di conference hall wey don full.

Addressing the crowd, Omo Agege yarn say he go run all-inclusive government if hin collect di mandate. Also, hin tok say nobody go dey victimized no matter where dem come from.

Omo Agege advise dem say make dem stand for truth and vote for APC, and to make Delta di state pride to dey reckoned with.

You fit go read di full gist…READ MORE