fbpx
April 23, 2024

Don Jazzy don enter gym after Tiwa Savage admit say hin dey handsome

don-jazzy-don-enter-gym-after-Tiwa-Savage-post-for-instagram

Popular singer and music producer, Don Jazzy don enter gym after songstress Tiwa Savage describe am as handsome man.

Songtress Tiwa Savage in di early hours of yesterday morning express her love for her former boss, Don Jazzy.

Tiwa Savage share video of Don Jazzy as hin dey dance to di new song titled “Stamina” and she tok say hin handsomeness don begin enter her eyes and she no fit hide am again.

FOR MORE NEWS: Don Jazzy dey enter my eye – Tiwa Savage

“Ahh Ahh let me not talk before they misinterpret my words but it’s as if Don Jazzy dey enter person eye like this”, Tiwa Savage said.

Inside new development, Don Jazzy don enter gym after di post wey Tiwa Savage drop for Instagram..

Don Jazzy write under di comment section, “Ahaa @Tiwasavage I don reach gym like this. #stamina loading. No Run o”.

In response, Tiwa comment, “Somebody cannot play with you again. Dis small waist that I am managing”.

You fit go read di tori…READ MORE