fbpx
April 19, 2024

May 29: We go stop any attempt to scatter handover — DSS give warning

dss-don-give-warning

Di Department of State Services yarn say dem don uncover plans by some pipo wey wan disrupt activities wey dey lined up for peaceful transition ceremony on May 29.
But di security agency don tok say dem no go allow such unpatriotic Nigerians to scatter di handover ceremony for any part of di country, DSS don give warning.

Also, di agency inside statement by di Spokesperson, Dr Peter Afunaya, on Thursday for Abuja, yarn say di motive of di pipo wey dey plan dat kain act na to undermine security agencies’ efforts at ensuring peaceful ceremonies as well as creating panic and fear among members of di public.

Di DSS ask Nigerians say make dem remain calm and law-abiding as security agencies dey on top of di situation.

 

FOR MORE NEWS: Japa: E go hurt our economy, MP condemn UK ban on families of foreign students

 

Based on di matter, citizens, media and Civil Society Organisations dey advised to adhere strictly to security and civil protocols during di events. Also, dem dey encouraged to shun fake news, false alarms, skewed reportage/narratives and sensationalism wey fit cause inflame division, tension and violence prior to and after di exercises.

You fit go read di tori , DSS don give warning…READ MORE