fbpx
March 28, 2024

Earthquake kill 640 people for Turkey and Syria

earthquake-hit-turkey-and-syria

Powerful 7.8 magnitude earthquake hit southern Turkey and northern Syria for mid night on  Monday, February 6, and e kill at least 640 pipo as at press time.

According to report, di earthquake destroy hundreds of buildings, and hundreds of people still dey trapped under di leftover of di destroyed buildings.

Turkish President, Recep Tayyip Erdogan, yarn for Twitter say di search and rescue teams don go di earthquake-affected areas.

Also, for hin tweet, hin wite say “dem hope say dem go get through this disaster together as soon as possible and with di least damage”.

According to Turkish officials, di death toll dey expected to rise as rescue workers search di demolition cities and towns throughout di region.

One resident yarn say three buildings near hin home for Adana, Turkey, collapse inside di earthquake.

 

Earthquake-Turkey-Syria

FOR MORE NEWS: CBN fit fine banks wey dey hoard new notes

Also, according to journalism student, Muhammet Fatih Yavus, another survivor bin dey call out from under di destroyed building, hin bin no get strength again but di rescue workers tried to reach where hin dey.

Turkey Disaster and Emergency Management agency yarn say at least 284 people bin die inside seven Turkish provinces, while 440 people get injury

Di death toll for government-held areas for Syria don climb to 237 with more than 630 wey get injury, according to Syrian state media.

At least 120 people kpai for rebel-held areas, according to opposition group, White Helmets.

You fit go read di full tori and watch di disaster of di earthquake for Turkey and Syria…READ MORE