fbpx
April 25, 2024

Governor El-rufai sack Kaduna House of Assembly clerk and three others

el-rufai-approve-bello-sack

Kaduna State Governor, Mallam Nasir El-rufai don approve di sack of Bello Zubairu Idris, Clerk of di Kaduna State House of Assembly.

Dem reveal dis matter inside statement by hin Special Adviser on Media and Communication, Mr. Muyiwa Adekeye

Di statement yarn say di Governor also approve di immediate disengagement of Yau Yunusa Tanko, a permanent secretary, and Francis Kozah, secretary of di Kaduna Enterprise Development Agency (KADEDA).

 

FOR MORE NEWS: Biafra: I go beg Tinubu to release Nnamdi Kanu – Soludo

 

According to di statement, di Governor don accept di retirement of Stephen Joseph, a permanent secretary for di state.

Report bin don tok how Governor El-rufai has vow to continue to sack bad persons and demolish structures wey dem build on Government land, until di eleventh hour.

You fit go read di tori as El-rufai approve Bello sack…READ MORE