fbpx
April 23, 2024

Announce rightful winners for Abia, Enugu or expect ENDSARS-like protests – Coalition

expect-endsars-like-protests-Coalition-express-concern-over-INEC-delay-for-Enugu-and-Abia-result

Di Coalition of South East Youth Leaders, COSEYL, don raise concern over INEC delay to declare di rightful winners of Abia and Enugu states governorship elections.

A statement by di President General of di coalition, Goodluck Ibem, yarn say di winners of Saturday elections for di two states no fit change.

Also, as di coalition express concern over INEC delay, dem claim say some element dey plan to manipulate di results of di March 18 governorship elections. Dis na for both Enugu and Abia, accuse di Peoples Democratic Party, PDP, say dem manufacture votes.

FOR MORE NEWS: US don condemn voter suppression for Lagos, ready to sanction perpetrators

According to di statement, di Obingwa East state constituency results wey INEC announce on the same day wey dem do di governorship election show say di total number of pipo wey voted for Obingwa East and West wey be di two state constituencies wey make up Obingwa Local Government Area, na 27, 912.

Hin ask say if 27,912 people vote for di election, from where PDP get 108,000 votes?

As e be so, dem dey call on INEC make dem no delay, but announce di rightful winner of di governorship election for Abia State and Enugu State in order to calm pipo mind wey don vex for both states.

Also, dem tok say any attempt to announce di wrong person as di winner of di governorship elections for Abia State and Enugu State go lead to protests worse than EndSARS.

You fit go read di tori…READ MORE