fbpx
April 20, 2024

FG don pledge digital empowerment for women in business

fg-digital-empowerment-for-women

Di Federal Government FG pledge digital empowerment for women in business and dem emphaize dia commitment to prioritize, promote and empower Micro, Small and Medium Enterprises, particularly women-owned ones for di Kontri.

Also, di Minister of State for Industry, Trade, and Investment, Mariam Katagum, tok dis one in commemoration of di 2023 International Women Day celebration wey dey organised by di Nigerian Association of Small and Medium Enterprises on Thursday.

Di minister yarn ay di theme of di event, ‘DigitAll: Innovation and technology for gender equality’ na di most appropriate considering di current global realities. She add say di technology don improve lives from better communication and facilitation to help connectivity.

“Gender equity na smart venture; however, to put women for innovation and technology dey much smarter.

FOR MORE NEWS: EPL: Arsenal don suffer fresh double injury blow ahead of Crystal Palace clash

As she dey tok about di importance of di internet, Katagum underscore di need for more investments wey dey toward increasing women and girl digital literacy and familiarity with technology.

She yarn say e go help dem fit participate effectively for  digital economy and gain access to digital services such as education, healthcare, and online banking.

Di minister recognize say women-owned enterprises don progressively increase over di years, and encourage women make dem embrace technology and innovation in their businesses.

You fit go red di full tori about di digital empowerment of women in business…READ MORE