fbpx
April 20, 2024

FG don ask for details of CONUA members for salary payment

fg-don-ask-for-conua-members-for-salary-payment

Di Federal Government don ask for di details of members of di Congress of University Academics for payment of withheld salaries. Dem run am through di Office of di Accountant General of di Federation. FG don ask for CONUA members for salary payment.

CONUA wey be rival union of university lecturers, bin divide themselves from Academic Staff Union of Universities since December 2022. Dem bin threaten to drag di Federal Government go court because of di withheld salaries of dia members. Dia members bin no dey part of di eight months ASUU strike, wey last from February to October, 2022. This na wetin dem try explain.

FOR MORE NEWS: Ayu neva put PDP account for public

According to dem, government know say di union no call for strike action and dia members no dey involved in di strike action wey last for eight months and wey shut down di university system nationwide.

For inside letter wey dem write, dem make am clear because CONUA dey run separate and independent union for di university system.

Dia point  be say di ‘No Work No Pay’ principle no suppose affect di union.

Di update now be say FG don ask for CONUA members for salary payment.

You go like read di full tori…READ MORE