fbpx
April 20, 2024

“Dis na treason, you dey desperate” – FG warn Peter Obi over comments on Tinubu

fg-warn-peter-obi-over-comments

As Federal Government  FG warn Peter Obi, dem yarn say na treason for di Presidential candidate of di Labour Party, LP, Peter Obi to incite pipo to violence over di outcome of di February 25 presidential elections.

Na di Minister of Information and Culture, Lai Mohammed, tok dis one for Washington DC during hin official engagements with international media organisations.

NAN reports say Mohammed so far dey engage with outlets like the Washington Post, Voice of America, Associated Press and Foreign Policy Magazine.

During one of di interactions, di minister yarn say e dey wrong for Obi to seek redress in court over di outcome of di polls and, in another breadth, incite people to violence.

FOR MORE NEWS: “Try mingle with better lawyers wey know Law” – Portable dey brag

Di man tok  say “Obi and hin Vice, Datti Ahmed, no fit dey threaten Nigerians say if di President-elect, Bola Tinubu of di All Progressives Congress (APC) dey sworn in on May 29, e go be di end of democracy for Nigeria.

Also, hin tok say na treason. FG look di matter, na why dem warn Peter Obi.

“You cannot be inviting insurrection, and this is what they are doing”. Na wetin hin tok be dat.

In addition, hin yarn say Obi statement na dat of a desperate person, and hin no be democrat wey he claim to be.

“A democrat should not believe in democracy only when he wins the election,” Na wetin Mohammed tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE