fbpx
April 24, 2024

Flooding, landslides don kill 36 for Brazil

flooding-and-landslides-kill-pipo--for-brazil

According to authorities on Sunday, Flooding and landslides wey torrential rain cause for Brazil don claim at least 36 lives on Carnival weekend for southeast Sao Paulo State.

TV and social media footage from di town of Sao Sebastiao show say di entire neighborhoods dey under water.  Waste materials from hillside houses follow di flood, including di cars wey fallen trees destroy, among other damage.

At least 35 people kpai inside Sao Sebastiaobecauseof di Flooding and landslides for Brazil, di state government na hin tok this one. Another news report yarn say one girl kpai for di town of Ubatuba.

Also di state civil defense chief, Henguel Pereira, tell di newspaper Folha de Sao Paulo say unfortunately, dem go get plenty deaths.

FOR MORE NEWS: New naira: FCT lawyers dey face frustration for filing proceedings

Another 228 pipo turn homeless and 338 dey evacuated form di coastal region north of di city of Sao Paulo. This na wetin di state government yarn earlier, as rescue crews rush go  help di pipo wey di storm hit.

Also, di authorities no give figure for how many people dey missing or injured.

Sao Paulo state governor Tarcisio de Freitas announce state of emergency for five towns along di coast after hin fly over areas wey di weather destroy. Also, hin free up di equivalent of $1.5 million for rescue operations.

You fit go read di full tori…READ MORE