fbpx
April 25, 2024

“I don’t regret running for office” – Funke Akindele don break silence on election loss

funke-akindele-don-break-silence

Deputy Governorship Candidate of di Peoples Democratic Party for Lagos State, Funke Akindele, don break her silence on her defeat for di March 18 elections, she yarn say she no regret running for office.

Akindele and her principal, Abdul-Azeez Adediran aka Jandor, dey defeated by di governor and All Progressives Congress candidate, Babajide Sanwo-Olu.

As Funke Akindele break silence on top her Instagram page on Monday, she write wetin she feel.

FOR MORE NEWS: Funke Akindele don delete her posts wey relate to politics after losing election

Also, she yarn say she don learn and unlearn. And she sincerely no regret taking di huge step of running for office.

In addition, she thank di people of Lagos state for believing in her and supporting her decision to run for office.

Following di outcome of di election, di actress delete all her posts wey relate to politics and di PDP from her Instagram page.

According to report on Monday, di posts wey dey on top her page of 15.7 million followers na dat of her movie promotion and other personal posts.

You fit go tread di tori…READ MORE