fbpx
April 19, 2024

How hin take get access to govt funds, Hin deserve life imprisonment – Nigerians react as dem arrest D’Banj for fraud

0
dbanj-

Di Independent Corrupt Practices and other Related Offences Commission, (ICPC) don arrest and detain Oladapo Oyebanji, wey dey known by hin stage name, D’banj.

Dem arrest di musician, detain am on Tuesday after ICPC operatives force am make hin surrender himself for di agency headquarters wey dey Abuja, Nigeria capital.

D’banj, insiders yarn say hin don dey dodge di summons for some weeks, and hin claim to dey overseas for scheduled concerts everytime wey hin dey invited to appear for interrogation over fraud allegation.

YOU GO LIKE READ: 6 Business Ideas in Nigeria to Start with Little Capital

Di singer, dey accused of fraudulently diverting hundreds of naira wey Nigerian government keep for N-Power project, an empowerment programme set up by di Nigerian government for 2016 to address youth unemployment and increase social development.

Investigators allege say D’banj plan with some compromised government officials to introduce ghost beneficiaries for di payroll of the scheme. Dem find out say di account wey dem dey divert di money to dey linked to di pop star.

The tori full ground…READ MORE

For more news: BBNaija star, JMK don answer di call to Nigerian Bar

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *