fbpx
March 19, 2024

“I Earn Over $40k (N20M) Monthly as A Skitmaker”- Broda Shaggi don open up

Skitmaker-Broda-Shaggi-don-open[-up-on-hin-earnings-for-content-creation-

Popular Nigerian skitmaker Broda Shaggi, wey hin real name na Samuel Animashaun Perry, don cause buzz on top social media after hin tok how about hin earnings on top content creation.

Di content creator, wey get 1.7 million subscribers on YouTube, for hin recent podcast interview with media personality Dadaboy Ehiz, open up say he dey earns more than N20M

Broda Shaggi tok say na consistency be di koko for skitmaking, and di more content creators produce, di more money dem dey make.

FOR MORE NEWS: Don Jazzy don enter gym after Tiwa Savage admit say hin dey handsome

Also, hin mention say to dey work with brands na another avenue for skitmakers to make money.

According to am, brands dey look for high numbers, views, comments, and reach when dem dey select influencers to work with. And na there di money dey come from.

Skitmaker Broda Shaggi earnings no dey limited to skit making alone, hin be actor, event host, and brand ambassador.

You fit go read di tori…READ MORE