fbpx
April 19, 2024

BREAKING: INEC declare APC Abdullahi Sule winner of Nasarawa governorship election

inec-declare-abdullahi-sule-of-apc-winner

Di Independent National Electoral Commission (INEC) don declare Gov. Abdullahi Sule and candidate of di All Progressives Congress APC as di winner. Dis na for di governorship election wey hold for Nasarawa State.

Na for Nasarawa State Collation Centre di Prof Ishaya Tanko, INEC State Collation Officer and Returning Officer make di declaration on Monday for Lafia.

Also, di INEC returning officer yarn say di APC candidate poll a total of 347, 209 votes. And,  hin defeat hin closest opponent, David Ombugadu, candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) wey get 283, 016 votes.

FOR MORE NEWS: “I am not a Yoruba man” — Labour Party Anthony Chinasa-Abiola don tok following win for Abia

In addition, di returning officer yarn say as Abdullahi Sule of APC satisfy di requirements of the law. Also, hin score di highest number of votes for di election. Abdullahi Sule of APC dey declared winner and returned elected”.

You fit go read di tori…READ MORE