fbpx
March 19, 2024

Nigeria ask Ireland support on security

Nigeria-ask-Ireland-on-internal-security for Nigeria

Di Federal Government FG on Wednesday ask for di cooperation of Ireland on internal security for Nigeria.

Interior Minister, Rauf Aregbesola make di request when di Irish Ambassador, Peter Ryan, visit am for Abuja.

During di meeting, di minister take style tok di plan of di ministry to establish di National Institute for Domestic Security.

Di proposed institute go be training ground for top security officers and an institution for inter-agency collaboration.

FOR MORE NEWS: BREAKING: Fire outbreak for Olowu spare parts market inside Lagos

“The National Institute for Domestic Security would provide a forum for interaction between top rank security personnel in managing internal security,” Na wetin hin tok be dat.

Aregbesola hail Ireland for dia legacy in education and moral instruction wey dem carry out through di Catholic Missionaries.

Inside hin remarks, Ryan thank di minister as dem receive am despite di short notice and hin assure hin country readiness to assist Nigeria.

You fit go di tori of Ireland on internal security for Nigeria…READ MORE