fbpx
April 25, 2024

Guber Poll: JAMB don Shift 2023 Mock UTME To March 30

jamb-don-shift-2023-mock-utme

Di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB don shift di 2023 Mock UTME wey dey planned for Thursday,16th March, 2023, to Thursday, 30th March, 2023.

Also, di board JAMB yarn say dem shift di date of di mock UTME because of di change in di date for di Gubernatorial and State Houses of Assembly Elections wey suppose hold on Saturday,11th March, 2023 but now dem move am to 18th March, 2023.

Di Head, Public Affairs and Protocol of JAMB, Dr. Fabian Benjamin inside statement yarn say candidates wey register early and wey show say dem wan take di Mock-UTME, go dey notified as to when dem need to print dia notification slips. Di slip go contain dia centres and other details.

FOR MORE NEWS: Buhari don break silence on cash crunch crisis, he say na CBN, AGF dey disobey Supreme Court orders

Furthermore, di Mock-UTME na optional examination wey di Board introduce to provide opportunity for candidates to get hands-on experience with di system. Also, di mock go give di Board opportunity to show di readiness and that of dia partners for di main UTME wey dey scheduled to hold between 29th April, to 12th May,2023.

Benjamin yarn say dis year UTME go witness some groundbreaking innovations wey dey aimed at addressing observed infractions and centre failures.

You fit go read di full tori…READ MORE