fbpx
March 28, 2024

JAMB to start registration of candidate for 2023 UTME by January 14

Di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, don come out announce say di registration for 2023 Unified Tertiary Matriculation Examinations, UTME go start for January 14, 2023.

Di board don also tok say di registration Direct Entry, DE for dis 2023 session go start from February 20 to April 20, 2023.

U FIT ALSO READ Allocate 26% of Nigeria annual budget to education – Don tell FG

Di spokesperson of di body, Dr Fabian Benjamin, na hin yarn dis one yesterday after di end of JAMB’s management meeting for Abuja.

Hin tok say: “ Di Board don alreadi approve di commencement of registration for di 2023 UTME from January 14 to February 14, 2023.

Dr Fabian tok say: “ All candidates need to take note say dem go need to pay di sum of N1,000 service charge for CBT centres for dem to do mock examination for where dey take register

Hin tok say “ Di Board, don fix April 29, 2023, for di starting of di 2023 UTME, which go con end on May 12, 2023. so anybodi wey don readi to register say make hin do am as quick as possible wen di time reach

To read di full tori CLICKHERE