fbpx
March 29, 2024

“I suppose loud my achievements” – Joeboy

joeboy-regret-as-hin-no-brag-about-hin-achievements

Joeboy, wey be well-known Nigerian singer wey hin real name na Joseph Akinfenwa Donus, dey regret as hin no brag about hin accomplishments loud enough.

Di musician reveal dis tori inside recent episode of di podcast “Body & Soul,” where hin stress how humility reduce hin worth for di music industry.

Joeboy make di revelation when dem ask about am wetin hin for do differently for hin career line despite hin success story as a singer.

Di singer of “Baby” admit say hin occasionally wonder whether he suppose dey more outspoken about hin artistic successes because hin cool behaviour dey make pipo ignore am.

 

Joeboy claim inside interview don spark mixed reactions from netizens. Some criticise am for being unnecessarily loud lately while others agreed with hin perspective.

See some reactions that followed …
@Juwon_soundz write: “Body and Soul Dey do podcast together.”

@OverGood_Boy write: “Which of dem be Joeboy ? I’m confused”

@itzkay_official: “This guy don Dey too talk lately”

@joshua_jimmy_ : “Abeg na who and who sit down there cause I don confuse”

@Damola0903: “Same thing happening to Fireboy,I wish he had been more loud about his achievements.”

@Thecapstore1 write: “Lol oga rest wetin you don achieve wey another person never achieve.”

You fit go read di tori as Joeboy regret as hin no brag…READ MORE