fbpx
March 19, 2024

Judgment Day: Tension for Osun as Adeleke, Oyetola know fate

judgement-day-for-osun-state-tension-dey-buid-up

A 3-man panel of di Appeal Court today, Friday, go deliver judgment for di legal battle between Osun State Governor, Senator Ademola Adeleke, and Adegboyega Oyetola.

According to report, tension and worry dey build up for di state.  Even supporters of different party wonder who di pendulum of di judgment for Osun State go swing to.

Adeleke of di Peoples Democratic Party, PDP, dey declared winner of di July 16, 2022 governorship election for Osun.  However, Oyetola of di All Progressives Congress, APC, claim say over-voting happen for some polling units. Dis na wetin make am immediately challenge Adeleke victory.

FOR MORE NEWS: Tinubu ‘hale and hearty, traveled abroad to rest’ – Keyamo

On March 14, di court bin reserve judgments for three appeals and a cross-appeal wey dey filed on di matter over di governorship election.

In addition, di appeals, filed by Osun State Governor Ademola Adeleke, hin party, di Peoples Democratic Party (PDP), and di Independent National Electoral Commission (INEC), dey against di January 27 judgment of the Osun State Governorship Election Tribunal. Di court bin void Adeleke victory for di July 16, 2022 election.

Di cross-appeal, wey dey filed by di All Progressives Congress (APC) and dia candidate for di election, Adegboyega Oyetola, dey against a portion of di tribunal judgement.

Also, reports yarn say di Osun State Governorship Election Petition Tribunal bin sack Governor Adeleke on di ground say he no score di majority of lawful votes cast during di July 16 governorship election for di state.

You fit like read di tori…READ MORE