fbpx
April 19, 2024

EPL: Klopp don single out three Liverpool players after 7-0 win over Manchester United

liverpool-win-manchester-united

Liverpool manager, Jurgen Klopp don lavish praise on Mohamed Salah, Cody Gakpo and Darwin Nunez follow dia 7-0 win over Manchester United on Sunday.

Nunez, Salah and Cody Gakpo score two goals each before Roberto Firmino add di last goal.

Salah second goal for di game make am become di Reds’ all-time top scorer for di Premier League, while Nunez don net eight goals.

Gakpo sef don start to dey find good form following hin January move from Ajax.

FOR MORE NEWS: Manchester United bidders don clear for next stage of takeover – Reports

Klopp yarn say: “Nobody dey in doubt about Darwin future impact because hin be real force of nature.

“But Cody (Gakpo) dey play for di most difficult area of di pitch against man-marking side, but hin still keep himself on hin feet and provides di overview for everyone else. And Mo is Mo!” Na wetin hin tok be that.

Also, di result boosts Liverpool chances of finishing for di top four, as dem dey three points behind fourth-place Tottenham.

You fit go read di full tori of Liverpool wey win Manchester United…READ MORE