fbpx
March 29, 2024

Manchester United bidders don clear for next stage of takeover – Reports

manchester-united-don-clear-for-next-stage

Bids from Qatar Sheikh Jassim Bin Hamad Al Thani and British billionaire Jim Ratcliffe to buy Manchester United don progress to di next stage of potential takeover, according to reports on Sunday.

Sky Sports and di Telegraph yarn say di bidders go get di opportunity now to conduct due diligence on di club by accessing detail financial information.

None of di bid wey dey reported don met di £6 billion ($7.2 billion) asking price of di current owners di Glazer family.

Di Americans dey deeply unpopular with United fans since dem load di club with huge debts via leveraged £790 million takeover fordi year 2005.

Also, di Glazers don oversee major decline for United fortunes for di field.

FOR MORE NEWS: “Na di pattern be dis”- Netizens don react to claim of JJC Skillz wey move go hin new wife house for Abuja 

Victory over Newcastle for last weekend League Cup final na di English giant first trophy for six years.  And dia last win for di Premier League title about a decade ago.

Qatari banker Sheikh Jassim dey aim to take 100 per cent control of di 20-time English champions and hin don earn support from some fans as hin pledge to wipe out United debt.

However, di Manchester United Supporters’ Trust don express concern over Qatar’s human rights record and di sporting integrity of owning both di Red Devils and French giants Paris Saint-Germain.

Ratcliffe’s INEOS company dey look to gain majority control of United by buying out di stake wey di Glazer family dey hold.

A self-proclaimed United fan, Ratcliffe na one of di UK wealthiest pipo with an estimated net worth of £12.5 billion due to di success of hin global chemical company.

You fit go read di full tori as Manchester United clear next stage…READ MORE