fbpx
April 20, 2024

Lagos guber election: MC Oluomo threats to Igbos na joke – Police

mc-oluomo-threat-to-Igbos-na-joke-police

Di Nigeria Police Force don react to di threats wey di Lagos State Parks Management Committee Chairman, Musiliu Akinsanya give. Hin dey popularly known as MC Oluomo wey threaten Igbos ahead of di state ahead of di governorship election.

Force spokesman, Adejobi Olumuyiwa, describe di threat by MC Oluomo against Igbos as a joke.

One video of MC Oluomo appear online as hin dey threaten Igbos for Lagos State against voting for another political party.

MC Oluomo yarn say Igbos wey no go vote for di All Progressives Congress, APC, make dem sit down for house.

FOR MORE NEWS: Aproko Doctor don share advice with women wey dey find BBL surgeries

 Reacting, di Force Public Relations Officer yarn say nobody get di right to stop di people of Lagos from voting for di candidate of dia choice.

Also, on top Channels Television, Olumuyiwa assure say di Lagos State Police Command don start investigation into MC Oluomo provoking comments.

According to am, hin see video of MC Oluomo with one mama Chidinma.  Na one Igbo woman wey tok say di threat no be true. Di police tok say na just joke hin dey make with one particular woman.

Di Commissioner of Police for Lagos don debunk di threat.  Also, MC Oluomo himself don tok say di threat to igbos na joke.

Di police tell Lagosians make dem go out vote for di candidate of dia choice.

You fit go read di tori…READ MORE