fbpx
April 18, 2024

Naira Marley dey stand with Sanwo-Olu for second term

naira-marley-stand-with-sanwo-olu

Naira Marley, for di late hours of Wednesday, March 15, take to Instagram live video to express himself and declare hin support for Sanwo-Olu.

Di ‘Soapy’ crooner claim say Sanwo-Olu na di best man for di job. Also, hin mention say important development for infrastructure and other aspects of di state, and hin tok say di public fit verify am.

As hin dey drum hin point home, Naira Marley tok say for di continuity and stability of Lagos, di state need man like Sanwo-Olu wey get experience and wey get knowledgeable based on wetin hin don do so far for di state.

FOR MORE NEWS: DJ Cuppy don graduate from Oxford University

He yarn say hin no be supporter of any political party, but he believe say Sanwo-Olu don do well. Also, hin tok say hin just dey tok hin own, no be say hin dey do promotion for Sanwo-Olu.

“I’m not (for the) All Progressives Congress, I’m not (for the) Peoples Democratic Party, I’m not (for the) Labour Party…but where Lagos is going right now, we don’t need to start testing at all. I think Sanwo-Olu is the right person for the job. This is not a paid promo or nothing. He has achieved a lot, he also has experience,” he said.

Di singer, wey dey known for plenty controversial stories, yarn say as a Nigerian, hin no fit dey silent on hin choice, as hin dey anticipate di regular backlash wey dey come when celebrity tok who be dia political choice.

You fit go read di full tori…READ MORE