fbpx
March 19, 2024

Nollywood actress, Nuella Njubigbo call for special prayers as she mark birthday in style

nuella-mark-her-birthday-in-style-today

Popular Nollywood actress and producer, Nuella Njubigbo dey celebrate her birthday today.

Di movie star and ex-wife of Tchidi Chikere dey mark her birthday with gratitude.

As Nuella dey celebrate her birthday today, she list out di plenty things wey she dey grateful for; life, love, new blessings, another chance and more.

She call on her fans make dem say a prayer for her.

“Another year is here! This year is special… So many things to be thankful for… Thankful for life…Love, Another chance, new blessings. Fam please say a prayer for me today. Happy birthday to Me. Happy birthday Anyanwu Ututu 1 na Al. Happy Birthday God’s favorite”.

FOR MORE NEWS: Omoni Oboli, Kate Henshaw react to opposition party threats for 2023 guber elections

Last year, Nuella Njubigbo bin mark her birthday and she no even care about her ex-husband new relationship.

Nuella Njubigbo share jaw-dropping photos to celebrate her birthday in di most beautiful way.

Inside post wey she share on top her Instagram page, Nuella Njubigbo describe herself as God’s special one and di rising sun.

You fit go read di full tori…READ MORE