fbpx
March 29, 2024

Peter Obi no dey behind fake news of CJN, Tinubu London meeting – Lawyer

obi-no-dey-behind-fake-news-di-Lawyer-debunk-Obi-involvement

Jibrin Samuel Okutepa, SAN, a member of Peter Obi Labour Party legal team for di Presidential Election Tribunal, don describe as fake di news wey claim say Chief Justice of Nigeria, Olukayode Ariwoola disguise for wheel chair to meet President-elect Bola Ahmed Tinubu. Also, di Lawyer debunk Peter Obi involvement for di purported tori.

On Thursday, online news media allege say di CJN meet Tinubu for London to influence di judiciary ahead of a presidential election tribunal hearing.

But on Friday, di Director of Press for di Supreme Court, Festus Akande, inside statement, debunk di news say na false.

Okutepa, inside series of tweets on top hin official Twitter handle on Friday, yarn say those pipo wey dey link di former Governor of Anambra State to di fake news just dey mischievous and satanic.

FOR MORE NEWS: Police Advise Nigerians to activate SIM lock, reveal criminals’ tactics

As di Lawyer debunk Obi involvement, hin yarn say Peter Obi get respect and confidence for di judiciary and that is why he approach di court for justice.

Also, he advise Nigerians make dem no bring di judiciary into disrepute and shame.

According to am, citizens must respect di men and women wey dey Bench.

You fit go read di tori…READ MORE