fbpx
April 20, 2024

Ogun accident,four pipol don kpai

0

Four pipol don change address go even inside one accident wen bi sele along Abeokuta-Sagamu expressway for ogun state on Thursday.

Mr Babatunde Akinbiyi, di tok tok persin for Ogun Traffic Compliance and Enforcement Corps (TRACE), confirm di incident to tori pipol for Abeokuta on Friday.

U FIT ALSO READ Three pipo die for Lagos-Ibadan Expressway lone accident 

Akinbiyi tok say di accident happun around 7:18 p.m. for Adedero in front of Adaranijo Filling Station,

Babatunde yarn say “ di pipol carry one Toyota Sienna with Number AAA 307 GN along di Abeokuta sagamu expressway, and one truck bin show behind wen belong to one cement company.

Di truck driver tok say hin no know say di car dey in front, not until hin see smoke from di front of di truck bifore hin con know say something don happun

According to tori we hear say all di pipol wen dey inside di car na male dem bi.and dey don alreadi carry dem go motuary of state hospital ijaye for Abeokuta

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *