fbpx
April 25, 2024

Business owners, churches no gree collect old Naira notes for Kaduna

Residents-dey-disappointed-as-sellers-reject-old-naira-notes-kaduna

Businessmen, transport owners, landlords, artisans and plenty other pipo no gree accept old Naira notes for Kaduna.

Also, different churches across Kaduna state on Sunday, no gree collect di old notes for offerings and tithes.

According to reports, you go remember say Supreme Court bin nullify naira redesign policy by di Central Bank of Nigeria (CBN). Also, dem extend di validity of di old naira notes till December 2023.

However, residents of Kaduna dey disappointed as foodstuff sellers, artisans no gree collect di old naira notes.

According to Alhaji Mustapha Amodu, wey dey sell baby food and other household items, di old notes no dey acceptable again. Hin add say if hin collect di old notes, banks go  reject am.”

FOR MORE NEWS: Desmond Elliot vs youth: Lagos Youths Vows to Deal with Desmond Elliot for Upcoming State Elections

Also, Mrs. Hannah Abraham, wey dey sell foodstuff for wholesale for Central Market, Kaduna, yarn say she no go accept old notes.

“Old notes no dey acceptable. If court don give judgement, make di president address Nigerians. Court judges no be bank managers wey go accept or reject di old notes. Make dem allow di CBN tok on di issue. No bank dey accept old notes again” this na wetin di woman tok.

Meanwhile, different churches across di state no gree accept di old notes as tithes and offerings.

You fit go read di full tori…READ MORE